Why Pope Francis give go-ahead to gay men to become priests

Di Vatican don approve new guidelines wey allow gay men to become priests as long as dem stay away from sex.
Di announcement na unexpected adjustment to practice in di Catholic Church, from di bishop go alow gay men to enta seminaries.
Although di Vatican in di past bin neva clearly ban gay men make dem no enter priesthood.
One 2016 instruction bin no allow men wey get “deep-seated homosexual tendencies”.
Na di Catholic Church for Italy bin draw up dis new guidelines in November but Vatican clergy office just confam am.
Di 68-page guidelines no follow for wetin di Pope bin tok in May, 2024 wen e bin say e get “already too much faggotry” among trainee priests wey dey Catholic seminaries.
E bin say , “frociaggine”, for Italian language wey many see as offensive.
Although no be for public e bin tok am, na for one meeting wit bishops e bin shelle.
Di Pope bin tok say e dey against gay seminarians wey dey lead “double life”.
E later tok sorry, say e bin no get mind to use homophobic language for one apology wey e bin send out.
Wetin dey di new guidelines
Inside di new guidelines wey dey di website of di Italian bishops’ conference, authorities say gay men from now on fit dey admitted to seminaries but only if dem dey celibate.
Di document say, trainee priests go need show “orientation towards celibate life”.
E bin further tok say Catholic Church “while e dey deeply respect pipo wey dem dey tok about, no fit admit to di seminary and to Holy Orders dos wey dey practise homosexuality, present deeply rooted homosexual tendencies or support di so-called gay culture”.
Instead, trainee priests suppose embrace chastity and celibacy.
Pope Francis, wey bin turn 88 last month, don receive praise sake of im tok about di LGBTQ community.
Sometin wey don dey happun since e become Pope in 2013.
Although di Catholic Church teachings tok say homosexual naturally no dey alright.
Weeks afta e succeed Pope Benedict XVI, e bin tok say “If pesin be gay and seek God and get goodwill, who I be to judge?”
In 2023, Pope Francis suggest say im dey open to Catholic Church blessing of same-sex couples.
E bin get some reaction from conservative Catholics sake of dis, While some priests bin welcome am as more relaxed guidelines.